Imagine if animals were to be on facebook,we'll be seeing posts and comments like............
MOSQUITO WALL POST:πππ
finally PHCN don off light,blood sucking things..
COMMENTS:
a):fuck up,dey don put on gen 4 my areaπ’π’π’
b)abeg bros which area u dey?my people don fleet house ohππ
DOG WALL POSTπ¦π¦π¦
Na wa oh.....i neva even stay reach 5 mins,all these calabar people don dey eye me..*ghost mode activated,them no go see me*escaping things on my mind.
COMMENTS:
My neighbour nah calabar too,the man eyes no good for where dogs dey....i go bite am soonπ π π π
RAT WALL POSTπ§π₯π¦
omo nah die i dey oh....no food for my master kitchen... na him books and certificate go suffer am, he think say i come im house to watch tv Mtchew!!
COMMENT
ur master stingy oo, chop im wife own too π
HE-GOAT WALL POSTπππ
heat mood activated, any she goat online 4 s*x chat please?
COMMENT
She goat: @he goat ,u're a capital BIG FOOL
he goat: @she goat:pretender,as if u no dey interested. carry ur smelling backside comot 4 here joor
COCK WALL POSTππ
All this hen go dey run lyk say dey no like me. But if u catch dem, dem go obey quickly, set 4 our usual style.....yeye ashawo hen ...lol
COMMENT
1) ur own beta nah, u dey still catch dem, d ones for my area na fast nd furious ooo....i don pursue tire conji wan kill me
2) My guy d ones for my area too spoil dey don finish my strength πππ
#Lol.
I am Chidex
No comments:
Post a Comment